Vladimir Putin don approve changes for di Russia nuclear doctrine wey don put for ground new conditions wia di kontri go reason to use dia arsenal.
Dem propose di update for September and na on Tuesday e rubber stamp am, on di 1,000th day of di war with Ukraine.
Dis dey also come afta Washington decision on Monday to allow Ukraine make dem fire long range US missiles enta Russia.

0 Comments